Aregbesola, Yayi, Others Become Friends With Constituents As Movement Agitated Resignation

This Sunday wey just pass, former Deputy Governor, HE, Adejoke Orelope Adefulire and former Hon. Oduntan lead some other party leaders go see Baba Agba, Oga patapata, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu for Bourdillon. For inside that waka, we see Alhaji Abiodun Ejigbadero, Prince Idris Balogun aka Oluomo Kafata, Engineer Akinyemi Ajigbotafe and other leaders like former Alimosho LG Chairmo, Hon. Fatai Shodimu, Alhaji Babs-Kareem, Mrs. Bola Afolabi and other big big pesin for inside Alimosho. Na surprising matter e be for those soldiers wey wan turn Alimosho upside down because of tiff-tiff say people like Ejigbadero fit go siddon dey reason matter with Asiwaju.

For many years now, one King-Kong wey cack for one corner of Egbe-Idimu inside Arida just carry the whole Alimosho party matter put for head like say na him Papa get APC. This matter no sweet people wey dey inside Alimosho, at all at all, sake of say these people no gree allow Alimosho grow, as dem just dey collect the money, dey share am among themselves. Dem just dey use council money buy house, buy cars and marry women.

Meanwhile, their Master Planner wey siddon for inside Abuja as Minister from Osun, na only him been sabi the road to Jagaban Villa. Him no dey allow anybody go near Asiwaju without him permission o. Anybody wey try am, go sharpally become Judas among him disciples.

But plenty people no know say Asiwaju house no be shrine and na so e no be grave. Baba dey receive visitors everyday from different different part of the country. People dey come from different places to reason politics matter with Baba.

All the people wey go, siddon reason Alimosho matter with Baba and dem follow snap pictures with am after their discussion. Baba receive with dem well well with sweet belle and na so him with Orelope just dey crack jokes as e be say dem be two old friends.

For people wey no know and for those ones wey dey pretend say dem no know, HE, Adejoke Orelope Adefulire, being a former deputy Governor, na she senior everybody for political hierarchy for inside Alimosho plus the remaining 5 LCDAs.

The matter make devil sef laugh when he hear say people wey belle dey pain on top the waka dey yarn up and down say Asiwaju no gree follow dem talk. Dem dey tell people say na pursue Asiwaju pursue dem comot for inside him house. This one no be only big lie but na also white lie.

Abeg, make una epp me show dem these picture o, as e be like say na after Asiwaju snap with dem finish, him come pursue dem comot.

Inside Alimosho, Yeye No Get Class.

Alimosho Liberation Movement
Sòrò Sókè

Comments

Popular posts from this blog

Enilolobo; Captain Of A Sinking Ship

Where Are the Promised Votes? - Ejigbadero

Trip To Ibadan: Enilolobo, Council Chairmen Plot To Break Party, Remodel BATCO Mandate